Home Search Countries Albums

God No Go Shame Us

PRINX EMMANUEL

God No Go Shame Us Lyrics


I call my brother for phone
Dey ask am how e dey be
Him tell me say mehn
Everywhere don red!! And e get as e be!
I tell am say no worry
As long as say we no dey mortuary
See!!
We de alive, we still de breathe
E get something weh I believe

[CHORUS]
God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us
The blessing go loud, e go worry the neighbors
God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us
The blessing go loud, e go worry the neighbors

Oga this one no be bobo
I know de talk wetin I no know
When the time go reach for you to collect your bread
You go collect jumbo
E don tey weh you don de grind
And e be like say your own never enter (enter)
But when dem go send the alert
Alaye dem no go use xender (eh)
As for me I no get issues
Eledumare de the middle, ah!
Na him de shower the blessing
So when I de sow I no wan needle! (Wan needle)
Somebody wan carry my picture go babalawo
I tell am to wait fes
Say that picture weh him wan use no fine
Make I send am the one weh go make sense
Because ehn!

[CHORUS]
God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us
The blessing go loud, e go worry the neighbors
God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us
The blessing go loud, e go worry the neighbors

A say God no go shame us
God no go shame us
God no go shame us

Enjoy Synced Lyrics With Our Mobile App

Download on Google PlayGet it on App Store

WATCH VIDEO

ABOUT THIS SONG


Release Year : 2020


Album : God No Go Shame Us (Single)


Added By : Farida

SEE ALSO

AUTHOR

PRINX EMMANUEL

Nigeria

Prinx Emmanuel is a musician from Nigeria. ...

YOU MAY ALSO LIKE