Home Search Countries Albums

The Traffic Song

COBHAMS ASUQUO

Read en Translation

The Traffic Song Lyrics


This traffic sef, na which day e wan end

Dear Lord, dear Lord, deliver man

Like play, like play, na one day we don spend

Dear Lord, dear Lord, deliver man

I don buy socks and water for hold up oo

Person don come wash my car for money

Dem say na port hole wey dey one side oo

Dear Lord dear Lord, deliver man, ouuuhh

Dear Lord dear lord, deliver man

Babi ala e don beg me taya

Dear Lord, dear Lord, deliver man

See that mopo, e wan burst my tyre

Dear Lord, dear Lord, deliver man

Some say na senator dey pass, e block road oo

Some say na pastor dey fight with police

Me I no wan know, I just wan reach house oo

Dear Lord, dear Lord, deliver man, ouuuhh

Dear Lord, dear Lord, deliver man

E get one babe wey dey wait me for house

Dear Lord dear Lord, deliver man

She say na me wey go tear her new blouse

Dear Lord, dear Lord, deliver man

I drink concoction for this occasion oo

My baby, please, do not start without me

See I don dey drive like a mad man now oo

Dear Lord, dear Lord, deliver man, ouuuhh

Dear Lord, dear Lord, deliver man

E get person wey must reach hospital

Dear Lord, dear Lord, deliver man

Only God fit save LASTMA official

Dear Lord, dear Lord, deliver man

LASTMA direct korope near my motor oo

The korope come bash my car for traffic

Na who go pay for my headlights now oo

Dear Lord, dear Lord, deliver man, ouuuuhhh

This traffic sef, na which day e wan end

Dear Lord, dear Lord, deliver man

Enjoy Synced Lyrics With Our Mobile App

Download on Google PlayGet it on App Store

WATCH VIDEO

ABOUT THIS SONG


Release Year : 2025


Album : (Single)


Added By : Farida

SEE ALSO

AUTHOR

COBHAMS ASUQUO

Nigeria

Cobhams Emanuel Asuquo is a Nigerian-born song writer/music producer/singer who started his academic ...

YOU MAY ALSO LIKE