Home Search Countries Albums

Illusions

BRYMO

Illusions Lyrics


You carry boyi go yonder, you say he no go oh
Slavers boku round town hin brother tell am oh
Stand for your ground, make you no hurry follow go
Them dey sell people troway, my brother no go oh
The people them wey go river them never return oh
Them say na mami water carry everybody go oh
For full moon, papa go farm he never return oh
Them say na the forest carry am swallow oh
Listen boyi, life no balance at all oh
You go place you no know, you no go return oh
Boyi feeling true, him heart dey beat for the road oh
Him fate na to follow them, follow journey go
Ah ah ah, ah ah ah
Wetin I think I become ah
Ah ah ah, ah ah ah
Na illusion them dey sell you so

Boyi look forth, him look out, no other place to go oh
He carry him few belongings, reluctantly follow go
For this life we dey, the things you do you know oh
E better to go reach the place find how e dey oh
I talk am, I shout am boyi still dey travel go
Na destiny dey push man where him dey go ah
He try am, he fight am, urge strong no be small
The tori e dey the place where him dey go ah
Ah ah ah, ah ah ah
Na wetin I think I become
Ah ah ah, ah ah ah
Na illusion dem dey promise you so

Oga master no wan know how him pig fat pass people oh
He say dem be property, with him dog dem equal oh
Boyi clean gun, he shave beard, Oga trust no other
He for adopt boyi, but him people hala
That night boyi take razor he shave am proper
The way Oga dey like am, no touch him moustache ah
Poison for soup, for family and the guys them
He slash master throat too from ear to ear ah
Ah ah ah, ah ah ah
Boyi na most wanted for strange country ah
Ah ah ah, ah ah ah
He dey gather soldiers ah
From plantations he dey break boys free

Enjoy Synced Lyrics With Our Mobile App

Download on Google PlayGet it on App Store

WATCH VIDEO

ABOUT THIS SONG


Release Year : 2022


Album : Theta (Album)


Added By : Farida

SEE ALSO

AUTHOR

BRYMO

Nigeria

Brymo is a musician, Songwriter, Performing/Recording and Poet. ...

YOU MAY ALSO LIKE